Download as docx, pdf, or txt
Download as docx, pdf, or txt
You are on page 1of 1

DJ Kenny Over a bottle of Gulder, The Wazobia Gazette editors spoke with DJ Kenny of Club Nouvelle. ...

in support of fan base papi... H: where you go sef, abi you go high? DJ Kenny: NO! I go see my friend; I no go high, why? H: Oya, wetin be your full name? DJ Kenny: I be Kehinde Ajigboye and I come from Ondo State. H: When you start to dey DJ and for where be dat? DJ Kenny: I start for the year 2003, August 3, and na for Ajegunle. H: So you be AJ Boy? DJ Kenny: Yeah! H: Which artists you don work with? DJ Kenny: I don work with Marvelous Benji, and I don also work with Run Gun. H: Run Gun, abeg who be dat? DJ Kenny: You go soon know. Run Gun na person whey me a just work with, him song na I no know say she day dat way. Him also sing about ganga! H: Which jams be the was whey be dis month flava? DJ Kenny: J Martins, DBanj, Clever J, Blackface, P-Square and Durella. H: You be like blackface fan, sef? DJ Kenny: Really! H: wetin you dey high on when you dey spin cds? DJ Kenny: Nothing oh! Once I just see people dey dance, e go dey give me morale. H: Which club be your dream club to play? DJ Kenny: K-55, Apapa. Bonus with Floo E don ever happen to you, wey be say people when come club no dance for your music? DJ Kenny: No, I sure about that one. Once I reach the venue, people dey happy say DJ Kenny don come. H: Whats your brand of beer? DJ Kenny: Stout! H: who are your musical influences? DJ Kenny: DJ Smile; because na him teach me work. H: Two years from now, where you go dey? DJ Kenny: I was dey Naija, because I believe say I go make am. H: YOU be rude boy abi, or righteous man, which one be all these gals? DJ Kenny: For me, I just like girlsjust to be friends. H: who is your one ideal woman? DJ Kenny: Rita; she is a professional dancer, living at Port Harcourt. H: And your fans? DJ Kenny: Make dem pray and wish me well.

You might also like