Download as docx, pdf, or txt
Download as docx, pdf, or txt
You are on page 1of 5

BBC News, Pidgin

Waka go wetin de inside

Plenti seshon

HomeNigeriaAfricaWorldVideoSportEntertainmentMost popular

Ghana Speaker of Parliament: Lawmakers vote NDC Alban Bagbin as new leader

6 January 2021

New Informate 7 January 2021

Mike Oquaye and Alban Bagbin, NPP and NDC nominees

WIA DIS FOTO COME FROM,OTHER

Wetin we call dis foto,

Mike Oquaye and Alban Bagbin, NPP and NDC nominees

Opposition NDC Candidate, Alban Bagbin win Speaker of Parliament election for Ghana. Per declaration
of de results, NPP dey control Executive arm of govment wey NDC dey control legislative arm of
govment.

NDC lawmakers bin dey inside jubilant mood ahead of de declaration of results afta de voting process to
determine who go be next speaker of Ghana parliament end.

Major tension bin dey for Ghana as NPP den NDC members clash over who go be de next Speaker of
Parliament.

After three attempts at voting since dem no fit reach decision as some members carry ballot box away,
others kick de box den tins over secret ballot concerns.

Armed military officials enter parliament to settle de matter but lawmakers insist dem for exit de
chamber.
Earlier, last minute ruling by one Cape Coast High court grant injunction against NDC Assin North MP-
elect, James Gyakye Quayson from holding himself as MP elect.

De court arrive at dis decision after petition filed by one Michael Ankomah who claim say de NDC MP-
elect dey hold Canadian citizenship at de time wey he file en application to contest in de December
election.

According to de judge, Kwasi Boakye said during en ruling "de NDC MP-elect for restrain from holding
himself as Member of Parliament-elect for the Assin North constituency within de Central Region of de
Republic of Ghana wey he no for present himself for swearing in as Member of Parliament-elect until de
final determination of de petition."

De judge make dis ruling on Wednesday, January 6, 2021, few gours to de dissolution of de 7th
Parliament, after around 12.01am on January 7, 2021 newly elected MPs go form de 8th Parliament
under de Fourth Republic.

Per dis ruling de NPP now get majority in parliament with 137 seats, while de NDC lose one seat which
dey give dem 136 seats.

De NDC MP-elect lawyers try file stay of execution against de court ruling but dem say de court clerks no
dey post at de time dem arrive.

John Mahama election petition be good for Ghana democracy – Nana Akufo-Addo

2021 prophecy by Ghana pastors - Yemi Osinbajo go become Prez

Dis be some of de key things to note from January 6 to January 7, 2021 when dem go swear in President
Akufo-Addo.

Dissolution of 7th Parliament

On Wednesday 6th January 2021, Ghana go dissolve de 7th Parliament around midnight, dis dey follow
Article 113(1) of de 1992 Constitution of Ghana.
After de dissolution, around 12:01am on 7th January, de Elected Members of de 8th Parliament go
gather for de Chamber of Parliament to elect a Speaker den Two Deputy Speakers.

After dis, de new Speaker go swear in de newly elected Members of de 8th Parliament.

In de morning of de 7th January, 2021 dem now for swear in President elect, Nana Akufo-Addo before
de newly constituted 8th Parliament.

Majority and minority fight over Speakership

De decision of who go be Speaker of Parliament make sketchy because of de number of seats both NPP
and NDC get each for Parliament.

Sake of dis, wen it comes to de voting for new Speaker, political analysts dey talk say dis be difficult
issue.

De NPP wan bring back Professor Mike Oquaye, who be Speaker of de 7th parliament wey one of de
people de NDC wan nominate as speaker be former NDC majority leader, Alban Bagbin.

However, de NPP be hopeful say when it comes to voting, de one independent candidate for Fomena
who previously be NPP lawmaker go vote give dem.

Members of de 8th Parliament go vote for Speaker, First Deputy Speaker, den Second Deputy Speaker of
Parliament.

After which de newly elected speaker who de 275 members vote for through secret ballot, go now
swear de new members in as lawmakers for Ghana.

January 7 swearing in of Prez


On January 7, 2021 dem go swear in President elect Nana Akudo-Addo before de 8th Parliament in
accordance with Article 57(3) of de 1992 Constitution of Ghana.

After de swearing in happen, de President go fit start en duties as head of state by appointing ministers
den things who he go work with.

Another thing we de for inside dis tori

Prophets Bempah and Gaisie

2021 prophecy by Ghana pastors: Yemi Osinbajo go become Prez, conflicting prophecies about John
Mahama election petition.

1st January 2021

President Nana Akufo-Addo

Ghana Election 2020: John Mahama election petition be good for Ghana democracy – Nana Akufo-Addo

5th January 2021

Top Tori

Eight celebrities and billionaires wey don show support for cryptocurrency

one hour wey don pass

Informate me

Prof. Wole Soyinka

Exclusive: Herdsmen don bring war come we domot - Prof Wole Soyinka

6th February 2021

Ngozi Okonjo Iweala WTO - World Trade Organization DG Candidate

Biden don pave way for Ngozi Okonjo-Iweala to make history for World Trade Organization

6th February 2021

Nigerian cryptocurrency

CBN ban on Cryptocurrency, how Atiku, Davido & oda Nigerians react

7th February 2021


1:47

Video,Wetin be di history of Ghana Braids?, Duration 1,47

4th February 2021

3:14

Video,Wetin you no know about Aisha Yesufu, Nigeria popular activist, Duration 3,14

3rd February 2021

See di new deadline date for NIN sim registration

2nd February 2021

2:45

Video,Meet di guys from Kwara state wey make aircraft from scrap, Duration 2,45

25th January 2021

See how you fit cash out of cryptocurrency trading sharp-sharp

6th February 2021

Wetin we know so far after Kano goment ban controversial imam from preaching, destroy im school

6th February 2021

BBC News, Pidgin

Why you fit trust BBC News

How dem dey take use am

As e concern BBC

Privacy Policy

Cookies

Call BBC

AdChoices / Do Not Sell My Info

© 2021 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.

You might also like